Sir Chief returns with My Helper, a heartfelt song inspired by real-life struggles, abandonment, and faith in God. The track reflects the pain of seeking help in difficult times and finding strength through perseverance and prayer.
With emotional lyrics and a soulful, street-rooted sound, My Helper delivers a powerful message of hope—reminding listeners that when human help fails, divine help never does.
My Helper is now available on all major streaming platforms.
My Helper – Sir Chief
Intro (Spoken softly)
Oh God, where you dey?
Help me now when I need help.
No be when I don die
Before I go get help.
Hook / Chant
Where you dey?
Where you dey for me?
Helper, where you dey for me?
Where you dey?
Where you dey for me?
Helper, where you dey for me?
Where you dey?
Where you dey for me?
Verse 1
People wey my papa help,
People wey my papa help,
Say dem no dey see me
When na time of need.
When na need help,
When na need help,
Now I dey ask:
Who go help me?
Who go help me?
The time reach, the time reach
For them to help me,
But everybody ignore me
Like say dem no dey see me.
I remember, I remember
When wahala jam dem,
Na our gate dem dey knock
Every day by day.
Now table don turn,
Nobody dey talk.
Everybody act like say
Dem no dey see me.
Oh my God, where you dey?
Chorus
Helper, where you dey for me?
Where you dey?
Where you dey for me?
Helper, where you dey for me?
Where you dey?
Where you dey for me?
Verse 2
Mama dey cry, mama dey cry,
I still dey try, I still dey try.
The street too hard for me, man,
But I still dey climb, I still dey climb.
Nephew lock door, cousin close eyes,
Papa people, oh my God.
Dem no pick call, dem no pick call.
Even friends dey avoid me,
Mama people abandon me.
Same people wey we help before,
Now dem turn back on me.
Destiny helper, na you I dey wait for.
Come take this burden away from me.
I get dream, but I need ladder.
I no go fall, I go strive harder.
Baba God, hear my voice.
Send helper wey go lift me higher.
Baba God, hear my voice.
Send helper wey go lift me—
Higher, higher, higher…
Higher, higher, higher…
Baba God.
Chorus (2x)
Helper, where you dey for me?
Where you dey?
Where you dey for me?
Helper, where you dey for me?
Where you dey?
Where you dey for me?







