STREAM/DOWNLOAD MP3
Magnito ft. Falz – If To Say I Be Girl Ehn Lyrics
[Intro]
Ah!
Magnito!!
If to say I be fine girl
It`s Tension Gang baby
[Verse 1 ”“ Magnito]
Ok! Let`s go
If to say I be girl eh
My guy go dey do G
And my song selection go be little bit of Jazz and a little bit of fuji
I go dey speak fonee
I go dey act like say the girl bad and she boujee
If I ever wanna eat, I`ll eat only steak and I`ll follow up with sushi
If to say I be girl eh
Man must open doors for me
E go open club for me, better one for that matter
Then again open store for me
He be cooking from morning to evening
Doing the dishes, e go even mop for me
He will do only what I ask for
E go be like say Juju dey work for me
[Chorus]
My life is all about car money money and wara wara mula
Money money and wara wara mula
Money money and wara wara mula
It`s the money money and wara wara mula
[Verse 2 ”“ Falz]
If to say I be Girl Ehn
I go dey bear Sister Maria
I no go fornicate
I no go follow man
Only do God and my career
Any body wey no help my spiritual life
I cut off like sharia (Get out of here)
And I go keep my cherry intact till I marry
Na my husband go pioneer
Na Lie
That`s Stereotype
Why I no fit be Oga
Why I no fit marry Mr billionaire
Why your papa wan dey tell me what to do
Not to talk of the cloth that I can wear (I am asking)
If to say I be girl eh
I no go even yell eh (I can`t shout)
I go dey live my life how I want
Make them say I no make wife material (I don`t care)
I no go let any bad guy come tell me what to do with my vagina
I be big girl I be Auntina, Ahn ahn
[Chorus]
My life is all about car money money and wara wara mula
Money money and wara wara mula
Money money and wara wara mula
It`s the money money and wara wara mula
[Verse 3 ”“ Magnito]
If to say I be girl eh
Hmmm
My market go dey sell eh
I go dey ball like the 90`s
You go think say Magnito na still Abedi Pele
If I waka pass Ibadan na everybody go dey gather
Dey hail me say ”˜Elle o`
Dem don dey clap, dem don dey hail
Before you know, you don carry belle
If to say I be girl eh
I will never ever pay for my Uber
Hausa language
I go enter only Range Rover, enter Mercedes
I no go enter any Acura
My life is just all about the chada chada wara wara mula
Money money and wara wara mula
Money money and wara wara mula
It`s the money money and wara wara mula
Ego!